DID YOU GET?
E get as e dey be for everybody. As a matter of fact, no be person suppose dey tell you this because we ma sef don dey see am with our naked eyes!
So, be calming down. E get why wey make them talk say something wey go up must jejely come down na force of gravity cause but we know say God hand dey am. If something wey belong to you dey up, it must surely come down come meet you but if e no greet come down, make you jejely go there go meet am for up! After all, it is said that if Muhammed cannot go to the mountain, let the mountain come to Muhammed.
Wetin I dey try yarn be say this life no easy but we no fit sit down just dey watch am. Do anything you can do to make money but no put your hand for bad thing oo. You see ritual killing bah, come out hand! You see yahoo yahoo bah, come out hand and you see prostitution bah, come out there! In fact, run leave am make your hands dey clean. Everly, God no go shame us!
I believe say you dey code me because oil dey your head and in one way or the other, one day, you shall find yourself looking back to say that you have tried. Just keep on doing good and your success stories are on the way!
I leave you to yourself.
Comments
Post a Comment